Monday 3 September 2007

Dear My Sister 6



Dear My Sister 6
Dear My sister,
I met my prospective fada in law for di first time last week. Despite intense preparations it was such an agonising experience. Ah-ah. E bi laik Dentist with dorti hand dey pull out 16 teeth from mai mouth without anaesthetic. Di man nearly vote mi out laik big brother, but I serve a God who never fails.
But before I give you that tori, make I digress. Which kain e- mail you send mi. Dey talk say you sef laik J the footballer. You no dey shame? A whole married woman. You even get di liver and the audacious venturesomeness to talk say if mai Omoge no laik di plenty flower wey J send, make we send am to you. My broad in law no fit buy you flower? Abi na vegetable soup you wan take am cook? Carry go ojare.
Ehen, di morning of di historic meeting , mai prospective moda in law don flash mi (di stingy woman), na im I return her call. Na she and im husband fly into London 2 nights ago. She yarn mi say her husband go gi mi tough time (as my Lepacious beauty na di Agbalumo of his eyes) but make I no worry. She promise mi complete immunity and protection. She even talk say if di man no gree mi marry dia daughter , she gaan go divorce di man.
WORKING ON BOOK FOLKS


Your brother crazy in love


Babawilly














4 comments:

Mommy said...

Babawilly! Babawilly!! Babawilly!!!
How many times have I called your name? I go just invite the girl papa come read ya blog.

Babawilly said...

Dear My mommy, You no fit do dat kain thing o. You sabi sabi na you bi mai acting mommy for dis blog. No let dem sack mi from romantic work o.
Yes na three times you halla mai name.

beebee said...

true,true you deh craze olohun ngbo

beebee said...
This comment has been removed by the author.