Thursday 13 September 2007

Dear My Sister 10 (The End)

Dear My Sister 10 (THE END)
Dear My Sister,
How bodi? Kasala don burst for mai street o! God forbid September 11.
But bifor I enta yawa tori make I nak you romantic yarns. I do spare key of mai Omoge flat wey she no know, den I go buy measures of red carpet from store. Meanwhile I take the day off o. Na so I construct red carpet from her drive way all the way to the side of her bed. Na so I dey sweat as I dey work. You sabi say I don become reformed Workaholic and an evolving Lepa-holic. Na Michael Jackson I sing sing as I dey work with the Stanley knife.
Uh mai Lepa
You gat mi working day and night.
I digress.


COMING OUT AS A BOOK SOON. SORRY FOLKS!

Yours truly crazy in love

Babawilly

12 comments:

Anonymous said...

wow, ahn ahn na story boku ur blog like this? Its kinda hard to cash up o, so i'll have to read it small small.

SOLOMONSYDELLE said...

me too

Babawilly said...

Chicala- No rush. Na smol smol
Solomonsydelle- Welcome and hope you enjoy the tori

princesa said...

Baba willy, i see ur pisho well well o! We get to change ur name to Taxi driver in the city.

princesa said...

LMAO!
See as one thing take lead to another!
That ya friend na real Terrorist abi na the lice wey jump out of him afro,lol!

I hope say u go invite me come dat ur wedding with ur omoge o! The only problem be say u fit abandon her for altar when u see me sha.

Babawilly said...

Princesa, abeg, mai Omoge dey read dis blog o. No put mi for trouble. Di engagement ring wey I give am, na non refundable. If she fshie mi, na you cos am.
As you don warm me, I go wear veil go the wedding so dat I no go fit shadow yua fine figure.

Rinsola said...

First taim hia. Long post indeed, i shall be back to finish up. But i must say you'v got an interesting blog. Have a great week ahead.

Babawilly said...

Welcome Rinsola. We are together

Mommy said...

"If I say di stress of the fire dey give mi backache, na so she go massage mai back for hours then e go begin dey put grapes for mai mouth."
I read that part and toppled in lafter. I just pictured you as Mr. Bean on the sick bed with that ugly nurse feeding him grapes. Haw haw hahahahahah haw!!

Babawilly said...

My dear mommy, which be Mr Ewa inside. Me I no gree for ulgy nurse anointing o. Ehen. It's all good

Afrobabe said...

hahahhahahahahahahahha I swear I am coming back here tomorrow...Its a date...in love with this blog already.and I dont fall that quickly.

Babawilly said...

afrobabe, welcome aboard. Love is truly in the air. see you tomorrow