Monday 3 September 2007

Dear My Sister 7





Dear My Sister 7
Dear My sister,
Sorry for the break up in communication. Hope mama is enjoying her time in Houston. It has been 2 months since my last letter.
Love is still in the air but so is money. Mai sister, I don hammer laik MC Hammer. I say I don hammer sotey awon boys for Jand dey call mi West Ham.
When God wan bless persin e dey bi laik joke. My Omoge tell mi say im dream say I dey plane dey go do deal. Few hours later mai friend, Nate, you sabi am now. Di one for Las Gidi. Im talk say make I follow am go China go buy cutlery.I come say we go fifty di investment costs and fifty di profit. Im gree. Wetin concern mi. Na so I enta plane commot.
We come join moni for di deal. You see, one hotel wan replace cutlery for all dia branches for Niaja and mai friend win di contract but im no sabi Knife and fork matter, na im take holla im longa throat friend; yours truly. (Abi no mi mi write Ukodo tonight?)
When we reach factory now, dem ask which brand name make dem put for cutlery. Mi I say Babawilly quick quick. Mai friend come talk say no man go gree im woman put spoon wey dem call babawilly for mouth. I come vex eh. See how we argue name of awa brand for one hour.
In di end, Chinese man settle us. Im say make we combine name. NateWill Cutlery na im we choose. Mai sister as soon as big people chop with awa cutlery dem begin beg hotel for awa details. Di rest as dem dey talk, na history.
WORKING ON BOOK FOLKS!!


Your brother crazy in love

Babawilly






14 comments:

Tokunbo Emmanuel said...

Hello Dr. Wilson! Great hearing from you. Please email me at israel@bwam.org

Great blog, my pidgin prof!

Sisbee said...

Interesting! Another Naija doctor blogger.Thanks for dropping by my pages. I honestly will make out time to read all your 'dear my sister' letters. Yep, I'm in the UK aiming to become like you soon ( I dey GP training) .I'll be returning to your page soon, and thanks for the advice.

Anonymous said...

Just passing by excellent writing will be back soon

♥♫♪nyemoni♫♪♥ said...

ROTLMHO! This is tew funny!!! Hahahaha.. What are these my dear sisters' posts about? I will take out time to read from scratch... Take care of you and thanks for stopping by mine...

Samantha said...

Great blog you have here. Thank you for passing by. I was honoured by your visit.

princesa said...

U are just a BIG clown!
I love ur blog.
Will be back soon.

Say hi to u omoge for me and we get to share the returns from that cutlery biz o!

laspapi said...

baba willy, you can't be saying these things about naija women, o!

Babawilly said...

Israel, wetin dey. I see say England fire you 3 Kondo. Owo melo la fin je eba?
Sisbee, Esprit de corps, by Abere we stand. No shaking.
Be silient, thanks for your comment.
Nyemoni, wetin dey? As you wan read from scratch, you go pay o.

Samantha, thanks for coming this way

Princesa, me I don spy you for your blog. No shaking, my Ijaw friends go kidnap you for me and package to UK like Umaru Diko (in reverse). Na that time you go sabi who bi clown. Its all good.
Laspapi, you know all Naija women are my sisters. They know I am only joking. Even the sef President wants to give me post - Minister of women affairs but I no gree.

Mommy said...

Minister ke! Thank God you no gree. So finally I have gotten to the seventh episode of dear my sister...you are funny! Big ups ehn! Ciao!

Manda said...

u try o! n to think i thot i was an expert in writing in pidgin lang! who dash u Taxi sef? abi na dat one be ur Black mecedes? Where dear sista reply?

Babawilly said...

Dear My mommy, No rest too much because Part 8,9 & 10 go soon commot laik Nollywood film.If President ah more money on top, I fit dey tempted
Dear My Mandy,Na mi write Pidgin English dictionary abi na you. Take time o. Ehen, Na mi bi honourary President of Taxi Union of Lagos.All taxis are mine. I don sell Black beauty. Na Benz (Not beans). Na Infiniti we dey Rock now. As for Sister reply, you get to know say woman wey gather 8 plus pickins for Yankee no get time to reply letter. Inetrnet ko, internet ni!

Anonymous said...

omg! u this babawilly u'r too funny abeg, . Ehen so whether pple wash their hands or not they'll cash typhoid if they no use ur cutleries?, lol.
Se na ur jeep be that taxi? Liking ur blog o no be small. Will be back.

Ms. Catwalq said...

Catwalq International Academie III is here!!!!!

Babawilly said...

Chicala. Make I tell you secret. Na Bobby Bension I dey follow. If you marry Taxi driver, i don't kia.
Persin wey dey find wife suppose know how to waka, and who waka pass Taxi driver?