Tuesday 28 August 2007

Dear My Sister 4


Dear Mai Sister 4
Dear My Sister,
Panic not. Ah-ah. Can’t you take a joke? Just because I mentioned poison you then carry go mention to Mama. Now di woman dey mai haus. She arrive from Las Gidi yesterday. Now I no fit dey go on dates laik before. Mama say na 1 year Visa dem give am. My sister, Mama go come play with you smol o for Texas bicos mi, I no send o.Mai relationship dey sensitive stage and mi I need quality time with my love.
Na you and yua big mouth cause dis panic. Now mama say na mi muss to buy her ticket as na mi frighten di family into sending her down to look her son. Na you go pay mai sister. Na you cause panic. Anyway make we no argue.
Dem don sack mi from Sunday teacher work o. Na mai fault sha. Na Memory verse scandal some people dey call am. You see, Pastor talk make everybody learn James 1:13. You sabi am now..When tempted, no-one should say, God is tempting me for God cannot be tempted with evil…
Mai sister , when I dey type Sunday school programme on Saturday night , dey listen to Barry White, I no know the time I type Songs of Solomon 1:13. Dat one e strong well well.
..My lover is to me a sachet of myrrh resting between my breasts.
My sister, for the first time in the history of the children’s church, everyone learnt memory verse o. Even one 2 year old, im brothers teach am.
Dem summon mi before elders. My sister, I come dey laff. I hear the allegations but na mai Lepa face I dey see. Dem say na toilet I go dey clean. I come make mistake ask ‘Male or female toilet?’. Mi I ask for information but dem look mi with eye bad like say I get bad thing for mind. (No bi Idris Mohammed sing dat song…Oh Lord, Please don’t let me be misunderstood?) I know say for dia mind na ‘get thee behind me satan’ dem dey think. Dem demote mi to car park. Na there I dey 2 weeks till dem come sack mi pata pata. You see, I been dey direct traffic but I reserve space next to mai Infiniti jeep for my Lepa. Pastor wife come arrive late ask if space dey. I say no (Technically I was not lying as the only space next to my Infinity Jeep was reserved for my Lepacious darling). Na dat day Pastor wife carry plenty books come church, but I no know. She go pack 5 streets away. As she dey struggle to waka come with her plenty load and children she see me dey direct Lepa into the parking space with a smile on mai face.
My sister, as I dey type so, I no get role for church again o. Pastor say I must appear im haus for counselling. Even mama no happy with mi. I juss dey laff dem. Love don anaesthetise mai brain. All di parents for church dey look mi bad eye say I teach dia pickin wrong memory verse. Na wetin sef. Na mi write Bible? Dis thing fit affect mai wedding presents o.
I dey too absent minded when I dey in love sef. Remember dat time in 1983. I been dey make breakfast for Papa. I fry egg, do ogi plus slice bread, dey sing love songs. I come set table den tell Papa say food don readi.
WORKING ON BOOK FOLKS

Your bros Crazy in love


Babawilly

6 comments:

Mommy said...

You are nuts! You are nuts nuts nuts!!! Hahahahahahaha! You are utterly hilarious. I laughed so hard I quite didn't get if I was laughing or crying. Now my co-workers think I've gone bunkers. You have made my day. I havn't read the other 'mai sista' episodes but I definitely will.
PS: You really a doctor?

Babawilly said...

Dear My Mommy,
Why you dey call me groudnut now?
No shaking. I will invite you to the wedding next year. Go and sew your cloth asap

Mommy said...

hehehehehehe
Wetin be d colour code o? lol

Babawilly said...

Dear My Mommy, Make mai mama for Lagos declare the color code den I go tell you. Which side of high table you go sidon. Right or left. You go spray mi moni o!! Also good wedding gift. God forbid tumbler and bathroom slippers as present. I serve a mighty God

laspapi said...

laughed thro this crazy write-up. You were having a peep at the dummy's cleavage? And you made pastor' wife walk because of lepa's parking space?

ps. mommy, babawilly's really a doctor

Babawilly said...

Laspapi, abeg talk smol smol make people no hear, ah-ah.

Anyway you are your brother's keeper for answering Mommy's question. But if she ask me if I want 1 million Dollars and you answer for mi, I fit vex smol