Tuesday 4 March 2008

Babawilly in Lagos 6




21-02-08. 9am
Where has all the time gone! Flying home tonight. Need to use my laptop in Birmingham so off to the computer place in Ikeja to buy my computer power cable. A kind of silicon valley. Nay. Valley of the dead. Nay , Valley of the dead but resurrected computers from Europe. Mai people come see pirated soft wear nyanfu nyanfu.Bought power cable and Tokunbo hand set. Had to take photographs but man dey fear to point camera. Had my camera on and held at waist level. I just dey snap dey go. Beng beng beng! I just dey go. Sebi if e no good I go delete.

22.20 hours Airbourne on KLM Flight 588. See blessings o! four seats to mai self. Ah, see as I stretch dey enjoi. Little did I know say witches and devil no happy as I dey enjoi First class leg stretch on economy ticket.
22-2-08. 05.15 hours
Land Amsterdam . Ah, I say make I go find duty free chocolate for loved ones. Na there the witches stud me o.
9.00 hours – Arrived Birmingham. Collected luggage and was on my way out when the ‘sniffer dog’ jumped on my hand luggage barking. Mai people , na chocolate hungry am?
Na so the woman dey question me rudely and me sef fire back. Me wey no smoke or drink for Lagos. As I answer back now, the woman see say im no fit intimidate me, so e begin search o. Me wey buy twenty pata go Lagos so dat I go dey change and no wash anyone- na me she commot all my dorti pata dey look for public, dey find drugs. Shame wey catch me eh?
Na so people dey pass dey look me corner eye. Dem go dey think say, ‘Eh, dis one wey dey read Bible inside plane, so na drgs im carry’.
The devil is a lair. I don put in letter of complaint to Custom. Wo, even if na Hague, we go reach there. God no go let dem disgrace persin. Nonsense and ingredients!!!!

8 comments:

Chris Ogunlowo said...
This comment has been removed by the author.
Babawilly said...

Chineke! 5 years work! You like me so?

All good

Chris Ogunlowo said...

Babywilly, no vex o na by mistake I take delete my comment. My system is messing up this morning. 5 years? What if Federal Government of Naija wan sponsor the project?

All too good ;)

Unknown said...
This comment has been removed by the author.
Unknown said...

LOL!! Na so those yeye customs people dey do. Thank God say u no gree carry Egusi na Dry Fish. Abi u carry? No mind dem O jare. Why u no share small chocolate with the dog now? LOL!! Welcome Back.

darkelcee said...

baba willy, devil is indeed liar. how can dey harrass you lie that?

but hey wetin dem come find? just curious sha lol

Babawilly said...

Darkelcee my sister. You for me or against?
Sebi if dem find something for di bag , na from prison I for dey send dis post with tears and cries of- why me why me.. you dey try me try me....

My hands are clean o. Na just my mind need deliverance...so help me God!

darkelcee said...

lawlllllllllllllll

i am not sure anyone fit sing that one for jail. lol

but em no be your portion by fire in Jesus name.

how body?

u gats to update fast