Tuesday 4 March 2008

Babawilly in Lagos 3



16-2-08
7pm. Left for Eko Hotel to attend Silverbird’s an audience with P-squared, sponsored by Cell-tell. Good show. D Banj, Wande Cole and some others dey perform. Some sang and some inflicted vicious decibels on us. The bouncers at the door eh! See muscles. I get ticket but I still fear to pass door. As I enter dem hand me toothbrush and Close up toothpaste. Chai! Abi mai mouth dey smell? I ask o. Dem say na dem be co-sponsor so dem must give everybody product. Mai mind settle. Virgin cola sef sponsor but their own na to line fine babes with tiny red shorts dey waka up and down dey give person Virgin Cola and Virgin Orange. Wetin concern hot pants and minerals? Remain small na Virgin condoms dem for dey give out.
Anyway, MCs for night were Wild child (you again!) and Koffi. They did well.
P-square come enter. Mai people see dance. Omo, na value for money (for those wey pay enta).
See craze. Four Lepa babes wey follow dem dance eh, dem get nuclear reactor for dem waist. Ah ah. Na radio active shaking dem do oh. I say make every woman hold im man tight for dis Lagos oh!
Soon audience members posed questions to Paul and Peter (P –squared). But which kain name be that? No be nursery rhyme of two birds sitting on the wall be dat?
Some of the more interesting questions-
Why pack a Hummer in-front of a rented apartment?
Answer- ‘If it was rented will I be knocking down walls to build a studio. Would I be digging a swimming pool in the back? The house cost 51 million Naira. Our lastest CD sold one million copies in six days’.
I am 8 months pregnant. Would you attend my child’s first birthday?
Answer – ‘Yes’.
Me I fear o. Pregnant woman come rock with us. I no dey duty o!
How do I appear on your next video?
Answer- ‘Come to the back and leave your number with our manager’. Shame no dey o. Remain small sef, me for go back stage and hand over mai number make I go pose for video.
When will you get married?

Answer- Not yet.
Can you two sit on me?

Answer- ‘Yes’. Na so the girl waka on stage them sit on am dey sing. Etc etc etc.

Best song for me was temptation. With its catchy tune- Pom pom pom- pom pom/ pom pom/ pom pom. This na temptation, with a little confusion..
Sounds like the defence of a law maker arrested by EFCC when quizzed on why he stole so much government funds.
In the end we had to leave. Ah, lets not forget. We were told to feel under our seats. Omo, dem sellotape New P-squared CD as gift. Not for everyone though. You sabi as some people dey get bad luck. God forbid.
Moral of the story - next time in a show in Nigeria, go early and check under all the seats!

No comments: