Tuesday 23 October 2007

Psalm 35 for the Financially Challenged

Psalm 35 for the financially challenged

Babawilly pray say….
Papa God, wund dem, wey wan wund mi !
Papa God, wear yua suit, carry yua brief case
Carry yua investment portfolio follow mi go meeting
Carry yua cheque book take finis all mai creditors.
Yarn mai soul say ‘I am yua Okada out of trouble’.

Baff dem wey wan kill mi.
Baff dem wit disgrace and shame.
Laik blom blow for wind, make angel pursue dem.
Make dem take dia white and white land yakata for poto poto
make yua angel pepper dem o!

I no beg for credit card, dem trap mi
I no ask for ‘buy now pay next year’.
But dem dig debt hole make I falli put.
Fiam! Yawa overtake dem
Fiam! Dia trap chop dia ankle
Fiam! Dia debt hole swallow dem.
Na dat time I go bubble in yua Holy Name.
Belle go dey sweet mi say you balance creditors all mai debt.
From bottom belle I throway salut.
Ta lo da bi re
Where you dey, who born monkey?
Na who but you go dash poor man?
Na who but you go protect poor tenant from wicked landlord?
Na who go protect suffer man from armed robbers?

Babawilly come pray say…….

Wicked people say make I pay for market I no buy
I give dem Eba chop dem take poison repay
I taya for mai life!
When dem no get, I lend dem moni.
I even fast and pray join
I sad for dem laik na mai Mama get di problem.
But now wey I owe, dem dey laugh
Dem join hand against me
People I no sabi, dem dey send me bill
with red ink everywhere
People yab! But moni yab pass!

Papa God, how long you go dey sidon look?
Ah ah! Rescue mi now!
Ah ah! Protect mi from di lions dem!
Na dat time I go come yua compound come praise you.
Even sef I go praise you on top AIT and CNN join.

No let dem do parti say I yamutu.
Make bad belle no laff mai tears
Dia mouth bad
Dia dagger dey find innocent Naija blood
Dem say I do di one I no do
Dem say na for dia kro-kro eye
Chineke se you dey see?
Talk put now. Bico no delay laik Dele.
Wake up o!
Transfer Kudi into mai account.
Yarn dem say I no owe moni
No do make dem fit talk for belle say
dem go suck mai blood finis
Take disgrace sew fine cloth for mai enemies
Take dishonour do dia cap

Papa God, bless dem wey helep mi get mai wealth
Make dia mouth do liak CD wey spoil
Just dey talk say ‘Great is di Lord, Great is di Lord wey dey enjoi
to dey bless im boi-boi dem’.
Na dat time I go do Amebo dey tell everi bodi tori
of di moni transfer wey you do for mi.
Papa God, I go hail you a thousand Gbosa all day long.
And I go hide inside the jeans wey you wear
As dem never born di tief wey go pick yua pocket.


Babawilly

Dr Wilson Orhiunu
27-01-2006







12 comments:

cally-waffybabe said...

LOL. someone sent me the Psalm 23 version and that was also funny.
Also, in case you've been trying to access my blog, just to inform you that i've shut it down. If you haven't already heard the reason why, long story...

I'll holla
xxx

Babawilly said...

Cally Waffy B -Wetin do your blog now?
Yes, I wrote pidgin version of Psalm 23 also. I have it somewhere on this blog. Hope you are keeping fine sha. I await e- yarns

princesa said...

LOL! I love the way you translated this psalm to pidgin.
Its my mum's fav paslm, she should read this ya version!

BTW, na who you dey owe?? Abi u don borrow money to take do wedding with that your opeke eh?? Oya tell us make we contribute for you o!

Babawilly said...

Princesa- Na yu bi my real sista. Abeg e mail di contribution to me for Xmas. If yua mama laik dis version sef, she fit contribute. Also ask Yar adua make im put hand (Moslem or no moslem)

Miss Opeke said...

Who could have written it better than you? No one...!!!
Thatz d gift that Baba God has give Baba Willy...
I go dey read diz psalm eferyday so God go answer my praya o

Thanx 4 sharing your gift with us...

Orientatednaijababe said...

AMEN AMEN AMEN.........Babawilly, i need help oh...foundation programme application form wan kill me oh....so na ur psalm i go dey recite every morning now.

Joy Akut said...

this ur version carry weight o...but seriously it makes more sense than the real thing cos u feel u're directing it at all the witches and wizards in ur village that dont understand when u pray against them in english...lol'...nice one

Afrobabe said...

Lol...for real mate..

"People I no sabi, dem dey send me bill
with red ink everywhere
People yab! But moni yab pass!"

just got some bills from BT full of red ink as well...

Babawilly said...

Miss iyabo opeke- thanks for your kind words. Very encouraging to me.
Oriented- nobody go kill you. God go do am.
Fantasy queen- Holy Ghost faya burn di witches complete.
afrobabe- Red ink to Black ink la gbara Jesu

Anonymous said...

you are very funny,I cant stop laughing here.

Naija Vixen said...

LMAO! Dis is hella funny, m still laffin real hard! iv heard the psalm 23 b4...but not this one! oh well! thanx 4 droppin by..x

Sylvester Omosun said...

your writing remind me of SOSSA boys by Ken Saro Wiwa