Showing posts with label Pidgin Prayers. Show all posts
Showing posts with label Pidgin Prayers. Show all posts

Tuesday, 23 October 2007

Psalm 35 for the Financially Challenged

Psalm 35 for the financially challenged

Babawilly pray say….
Papa God, wund dem, wey wan wund mi !
Papa God, wear yua suit, carry yua brief case
Carry yua investment portfolio follow mi go meeting
Carry yua cheque book take finis all mai creditors.
Yarn mai soul say ‘I am yua Okada out of trouble’.

Baff dem wey wan kill mi.
Baff dem wit disgrace and shame.
Laik blom blow for wind, make angel pursue dem.
Make dem take dia white and white land yakata for poto poto
make yua angel pepper dem o!

I no beg for credit card, dem trap mi
I no ask for ‘buy now pay next year’.
But dem dig debt hole make I falli put.
Fiam! Yawa overtake dem
Fiam! Dia trap chop dia ankle
Fiam! Dia debt hole swallow dem.
Na dat time I go bubble in yua Holy Name.
Belle go dey sweet mi say you balance creditors all mai debt.
From bottom belle I throway salut.
Ta lo da bi re
Where you dey, who born monkey?
Na who but you go dash poor man?
Na who but you go protect poor tenant from wicked landlord?
Na who go protect suffer man from armed robbers?

Babawilly come pray say…….

Wicked people say make I pay for market I no buy
I give dem Eba chop dem take poison repay
I taya for mai life!
When dem no get, I lend dem moni.
I even fast and pray join
I sad for dem laik na mai Mama get di problem.
But now wey I owe, dem dey laugh
Dem join hand against me
People I no sabi, dem dey send me bill
with red ink everywhere
People yab! But moni yab pass!

Papa God, how long you go dey sidon look?
Ah ah! Rescue mi now!
Ah ah! Protect mi from di lions dem!
Na dat time I go come yua compound come praise you.
Even sef I go praise you on top AIT and CNN join.

No let dem do parti say I yamutu.
Make bad belle no laff mai tears
Dia mouth bad
Dia dagger dey find innocent Naija blood
Dem say I do di one I no do
Dem say na for dia kro-kro eye
Chineke se you dey see?
Talk put now. Bico no delay laik Dele.
Wake up o!
Transfer Kudi into mai account.
Yarn dem say I no owe moni
No do make dem fit talk for belle say
dem go suck mai blood finis
Take disgrace sew fine cloth for mai enemies
Take dishonour do dia cap

Papa God, bless dem wey helep mi get mai wealth
Make dia mouth do liak CD wey spoil
Just dey talk say ‘Great is di Lord, Great is di Lord wey dey enjoi
to dey bless im boi-boi dem’.
Na dat time I go do Amebo dey tell everi bodi tori
of di moni transfer wey you do for mi.
Papa God, I go hail you a thousand Gbosa all day long.
And I go hide inside the jeans wey you wear
As dem never born di tief wey go pick yua pocket.


Babawilly

Dr Wilson Orhiunu
27-01-2006







Wednesday, 1 August 2007

Pidgin Version of Psalm 23


This poem is easily more famous than me or my book. The Pidgin version of Psalm 23. Written and published on the internet at about 2000 and published in my book- My Time in 2005.

SAM TWENTI TIRI

The Lord is mai shepherd
I dey kampke
He make mi sidon for where betta dey flow
Come put me next to stream wey make mai bodi
Thermacool
He panel beat mai soul come spray am white,
Come dey lead me dey go ni, through express road of righteousness for His name’s sake
Walahi!, if I waka pass where arm robber, 419
And juju pipo borku come even join okada reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth. Your rod and staff nko?
Na so-so comfort dem dey comfort me for belle
You don prepare Banga and starch make I chop
All mai enemies dey look anyaya
You anoint me for head wit oil
Mai cup na Ogunpa wey burst im banks
True true, betta life and mercy go gum mai back
Till I quench. And man go tanda for God house sotey sotey; from Lai lai to lai lai.
GOD ALMIGHTI, NA YOU BICO.

Dr Wilson Orhiunu
My Time. 2005