Tuesday 10 June 2008

Pslam Twenti


Psalm Twenti
1.
May Papa God tek yua calls wen yua wata don pass Garri,
may im name corva yu laik corva cloth for harmattan nait.
2.
May Papa God message area angels dem from im parlour to yu,
mek dem Western Unionize yua account with transfer from Zion.
3.
Mek God no forget yua tithes and offering
4.
Mek God gi yu dat thing wey dey hungry yu so, so dat all yua plans go bo si.
5.
We go follo yu halla and jollof wen yua own come betta.
We go carry Papa God name up laik Naija flag for Octoba first.
Mek God ansa all yua praya complete.
6.
I don see say Papa God dey save im persin, dey pick dia calls,
come text back strong strong blessings wit im right hand.
7.
Some put mind for bullet proof moto,
some na dia security guards, but we put all awa mind on top Papa God
8.
Dem fall down yakata! But we denge, dey set laik majestic Iroko inside bush.
9.
Papa God, save yua pickin. We kneel down dey beg, no ansa awa call wit voice message.




Dr Wilson Orhiunu
Babawilly

10-06-08

16 comments:

The Activist said...

Kai, Babywilly this one is funny o espcially number 3!!!

Make sure my comment does not disappear again o or else, i go vex

Babawilly said...

Ah, Standtall, afliction will not arise a second time o. Impossican't!

The Activist said...

Okay o. this is a relief. (lol)

Yankeenaijababe said...

Now,that's very hilarious.. Thumbs up. I loved that. Did you see the poem I wrote for my mum in pidgin for Mother's day. That was funny too.

WeirdGurl said...

Happy father's day.
http://weirdbabe.blogspot.com/

Chris Ogunlowo said...

LMAO...

How bodi?

princesa said...

Wow! So you still doing things Baba Willy?
Nice one man...missed ur blog.

Babawilly said...

Hi Aloofar, How bodi to you too. Today's the day after the nite before- Father's day jollifications. Got an inflatable 'super Dad' baloon and a gaint 'sign board' father's day card.
All good. Na make dem get job I dey wait. Will see who is the first to buy me a Bently.
Princesa, long time. Hope Lagos dey.
Hoping to do my book launch some time August in Lagos God willing. All bloggers will be invited

Lady said...

HAHHAHAHHAHAHAH!!!!!!!!!! AM SERIOUSLY CRACKING UP!!!!!!!! "NO ANSA OUR CALL WIV VOICE MSG" HAAHA"AMEN OO"....

Today's ranting said...

Wow babawilly i enjoy this thing wel wel ooo. i've heared about you and na gud thing sey i come stumble on ur blog today. your pidgin na helele ooo.

Babawilly said...

Lady Koko, welcome. Happy you liked it. Today's ranting thanks for the kind remarks. Very encouraging to me.

Babawilly said...

yankeenaijachick- thanks. Have been to your page. Loved your poem to your mum.
weirdgurl, wetin dey? hope you are fine. Thanks

Today's ranting said...

Oh oh why u con loss my comment naaa.I enjoy this ur post wel wel and ur pidgin na helele.

Today's ranting said...

My comment dey there naaa n u sey u loss am. lol!

Varney said...

Lol! Great stuff.Used to love going to that naijaindex place, just for babawilly short stories et all.
Abeg, na whush time yu go write complete bible for pidgin? Na dat one me dey wait na.

Oluchi said...

Lol! Great stuff. used to love going to that naijaindex place just for babawilly short stories et all.
Abeg, na whush time u go write whole bible for pigin, na dat one me dey wait for na?