Monday, 17 September 2007

1-0 to the Blues




Good day last saturday. 15-09-07.
U16s & U18s of Birmingham City FC both defeated the corresponding teams from Crystal Palace FC; 1-0. Owo me lo la fin j'eba. One Kondo!
From there (Bham City training ground) it was straight to the main joint - St Andrews. For the 1-0 defeat of Bolton FC.
Diouf was a real character. He infuriated the home crowd (us) and his every move was booed.
He went for a corner kick and the monkey chants started. (I remembered I was still in England). Kick racism out of football ko, kick racism out of Ludo ni.
The impressive thing about Diouf is that he improves with the booing.
Anelka was a bit quiet for Bolton.
Its all good.

Thursday, 13 September 2007

Dear My Sister 10 (The End)

Dear My Sister 10 (THE END)
Dear My Sister,
How bodi? Kasala don burst for mai street o! God forbid September 11.
But bifor I enta yawa tori make I nak you romantic yarns. I do spare key of mai Omoge flat wey she no know, den I go buy measures of red carpet from store. Meanwhile I take the day off o. Na so I construct red carpet from her drive way all the way to the side of her bed. Na so I dey sweat as I dey work. You sabi say I don become reformed Workaholic and an evolving Lepa-holic. Na Michael Jackson I sing sing as I dey work with the Stanley knife.
Uh mai Lepa
You gat mi working day and night.
I digress.


COMING OUT AS A BOOK SOON. SORRY FOLKS!

Yours truly crazy in love

Babawilly

Dear My Sister 9

Dear My Sister 9
Dear My Sister,
Life is good. Summer time is beautiful. The leaves look green and the sky is adorned in a majestic blue garment. Mai Infiniti jeep dey kampe and I have got Will Smith’s Summer time blasting from my speakers. You see mai sister, mai Omoge loves Will Smith and so must I. I have watched I-robot about 8 times so far. You see, mai Omoge is very spiritual. She says seeing all those robots marching in unison takes her to the Valley of Dry Bones. You sabi now. Ezekiel 37. She come prophesy say as those robots dey waka, na so all the dry bones and dead dreams for mai life go stand up begin waka. I gat to open one eye as we dey pray to make sure say she dey alright.


COMING OUT AS A BOOK SOON. SORRY FOLKS!

Yours truly crazy in love



Babawilly

Dear My Sister 8

Dear My Sister 8
Dear My Sister,
Back in and back in trouble! I note your silly text; what is the state of my heart? How would I know? Ask my cardiologist. Na she tief my heart go and its locked in a bank vault somewhere in Switzerland beyond the claws of EFCC. I even hear say dem don loss di key and duplicate copy no dey.

COMING OUT AS A BOOK SOON. SORRY FOLKS!




Yours truly crazy in love


Babawilly

Monday, 3 September 2007

Dear My Sister 7





Dear My Sister 7
Dear My sister,
Sorry for the break up in communication. Hope mama is enjoying her time in Houston. It has been 2 months since my last letter.
Love is still in the air but so is money. Mai sister, I don hammer laik MC Hammer. I say I don hammer sotey awon boys for Jand dey call mi West Ham.
When God wan bless persin e dey bi laik joke. My Omoge tell mi say im dream say I dey plane dey go do deal. Few hours later mai friend, Nate, you sabi am now. Di one for Las Gidi. Im talk say make I follow am go China go buy cutlery.I come say we go fifty di investment costs and fifty di profit. Im gree. Wetin concern mi. Na so I enta plane commot.
We come join moni for di deal. You see, one hotel wan replace cutlery for all dia branches for Niaja and mai friend win di contract but im no sabi Knife and fork matter, na im take holla im longa throat friend; yours truly. (Abi no mi mi write Ukodo tonight?)
When we reach factory now, dem ask which brand name make dem put for cutlery. Mi I say Babawilly quick quick. Mai friend come talk say no man go gree im woman put spoon wey dem call babawilly for mouth. I come vex eh. See how we argue name of awa brand for one hour.
In di end, Chinese man settle us. Im say make we combine name. NateWill Cutlery na im we choose. Mai sister as soon as big people chop with awa cutlery dem begin beg hotel for awa details. Di rest as dem dey talk, na history.
WORKING ON BOOK FOLKS!!


Your brother crazy in love

Babawilly






Dear My Sister 6



Dear My Sister 6
Dear My sister,
I met my prospective fada in law for di first time last week. Despite intense preparations it was such an agonising experience. Ah-ah. E bi laik Dentist with dorti hand dey pull out 16 teeth from mai mouth without anaesthetic. Di man nearly vote mi out laik big brother, but I serve a God who never fails.
But before I give you that tori, make I digress. Which kain e- mail you send mi. Dey talk say you sef laik J the footballer. You no dey shame? A whole married woman. You even get di liver and the audacious venturesomeness to talk say if mai Omoge no laik di plenty flower wey J send, make we send am to you. My broad in law no fit buy you flower? Abi na vegetable soup you wan take am cook? Carry go ojare.
Ehen, di morning of di historic meeting , mai prospective moda in law don flash mi (di stingy woman), na im I return her call. Na she and im husband fly into London 2 nights ago. She yarn mi say her husband go gi mi tough time (as my Lepacious beauty na di Agbalumo of his eyes) but make I no worry. She promise mi complete immunity and protection. She even talk say if di man no gree mi marry dia daughter , she gaan go divorce di man.
WORKING ON BOOK FOLKS


Your brother crazy in love


Babawilly














Tuesday, 28 August 2007

Dear My Sister 4


Dear Mai Sister 4
Dear My Sister,
Panic not. Ah-ah. Can’t you take a joke? Just because I mentioned poison you then carry go mention to Mama. Now di woman dey mai haus. She arrive from Las Gidi yesterday. Now I no fit dey go on dates laik before. Mama say na 1 year Visa dem give am. My sister, Mama go come play with you smol o for Texas bicos mi, I no send o.Mai relationship dey sensitive stage and mi I need quality time with my love.
Na you and yua big mouth cause dis panic. Now mama say na mi muss to buy her ticket as na mi frighten di family into sending her down to look her son. Na you go pay mai sister. Na you cause panic. Anyway make we no argue.
Dem don sack mi from Sunday teacher work o. Na mai fault sha. Na Memory verse scandal some people dey call am. You see, Pastor talk make everybody learn James 1:13. You sabi am now..When tempted, no-one should say, God is tempting me for God cannot be tempted with evil…
Mai sister , when I dey type Sunday school programme on Saturday night , dey listen to Barry White, I no know the time I type Songs of Solomon 1:13. Dat one e strong well well.
..My lover is to me a sachet of myrrh resting between my breasts.
My sister, for the first time in the history of the children’s church, everyone learnt memory verse o. Even one 2 year old, im brothers teach am.
Dem summon mi before elders. My sister, I come dey laff. I hear the allegations but na mai Lepa face I dey see. Dem say na toilet I go dey clean. I come make mistake ask ‘Male or female toilet?’. Mi I ask for information but dem look mi with eye bad like say I get bad thing for mind. (No bi Idris Mohammed sing dat song…Oh Lord, Please don’t let me be misunderstood?) I know say for dia mind na ‘get thee behind me satan’ dem dey think. Dem demote mi to car park. Na there I dey 2 weeks till dem come sack mi pata pata. You see, I been dey direct traffic but I reserve space next to mai Infiniti jeep for my Lepa. Pastor wife come arrive late ask if space dey. I say no (Technically I was not lying as the only space next to my Infinity Jeep was reserved for my Lepacious darling). Na dat day Pastor wife carry plenty books come church, but I no know. She go pack 5 streets away. As she dey struggle to waka come with her plenty load and children she see me dey direct Lepa into the parking space with a smile on mai face.
My sister, as I dey type so, I no get role for church again o. Pastor say I must appear im haus for counselling. Even mama no happy with mi. I juss dey laff dem. Love don anaesthetise mai brain. All di parents for church dey look mi bad eye say I teach dia pickin wrong memory verse. Na wetin sef. Na mi write Bible? Dis thing fit affect mai wedding presents o.
I dey too absent minded when I dey in love sef. Remember dat time in 1983. I been dey make breakfast for Papa. I fry egg, do ogi plus slice bread, dey sing love songs. I come set table den tell Papa say food don readi.
WORKING ON BOOK FOLKS

Your bros Crazy in love


Babawilly